Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, João da Silva
- Role, Business reporter
TikTok now dey available for di US Apple and Google app stores afta President Donald Trump postpone di enforcement of ban for di Chinese-owned social media platform till 5 April.
Di popular app wey get ova 170 million American users bin off for short time last month as d date of di ban bin dey draw near.
Trump come sign executive order to give TikTok 75 day extension to comply to law wey ban di app if dem no sell am.
TikTok no immediately respond for request to follow BBC News tok.
According to Bloomberg, wey first report di tori say TikTok don come back app stores for di US, di decision to resume dia availability bin come afta di assurances wey Google and Apple get from di Trump administration say dem no go dey liable to allow downloads and di ban neva dey enforced yet.
Di ban bin pass Congress wit bipartisan voters and na former President Joe Biden sign am into law. E bin order TikTok Chinese owner ByteDance to sell di US version of di platform give neutral party or else dem go ban dem.
Di Biden administration bin argue say China fit use TikTok as tool for spying and political manipulation.
China and TikTok don deny dat kain accuse plenti times. Beijing bin also refuse calls make dem sell TikTok US operations.
Di law wey ban di app bin dey supported by US lawmakers for both parties and Supreme Court even stamp am.
Trump gan-gan bin don support di ban during im first term for office but e be like say e don change im mind last year during im presidential race.
E tok say e get “warm spot” for di app, say e get billions of views for im videos for di platform for last year presidential campaign.
Wen di app bin start to dey work again for di US last month, di message wey dem send give dia millions of users na to tank Trump by name.
TikTok CEO Shou Chew bin go meet Trump for Mar-a-lago afta im win election for November and later attend di inauguration.
Trump don say e go find compromise wit di Chinese company wey go comply wit di spirit instead of di letter of di law. E even bring idea say TikTok suppose dey jointly owned.
E tok for news conference about artificial intelligence say, “Wetin I dey tink be say pesin go buy am and give half to US and we go give una permit.”
And e don also tok say e dey open to selling di app to Oracle co-founder Larry Ellison, and also billionaire Elon Musk, wey dey currently head di Trump administration Department of Government Efficiency.
Former pipo wey bin dey linked say dem wan buy di app na billionaire Frank McCourt and Canadian businessman Kevin O’Leary wey be celebrity investor for Shark Tank.
Di biggest YouTuber for di world Jimmy Donaldson wey dem dey call MrBeast say im sef dey di running afta some investors contact am as e post for social media say e dey interested.